Authority Stealing by Fela Kuti

Image result for fela kuti

Authority Stealing by Fela Kuti

Authority stealing!
You be thief (I no be thief)
You be rogue (I no be rogue)
You dey steal (I no dey steal)
You be robber (I no be robber)
You be armed robber (No be armed robber)
I no be thief (You be thief)
I no be rogue (You be rogue)
I no dey steal (You dey steal)
I no be robber (You be robber)
I no be armed robber (You be armed robber)
[Chorus]
Argument, argument!
Argument, argument, argue
Them argue - Everbody dem argue
Them dem dem argue - Up and down them argue
Everbody dem argue - Them dem dem dem argue
Yes yes, them argue - Everbody dem argue
Argument about stealing - Somebody don take something
Wey belong to another person - Then you go hear:
You be thief (I no be thief)...

On top of the road, on the side - People dey waka
Office workers, labourer workers, workers' workers - Them go dey waka
Inside bus them go dey - Motorcycle them dey ride
Plenty, plenty crowd - Inside this crowd
Sometimes for one corner - Sometimes for one street
You go dey hear: ha ha!

[Chorus]
Thief, thief, thief!
Rogue, rogue, rogue!
Robber, robber!

Catch am, catch am! Thief, thief, thief!
Catch am, catch am! Rogue, rogue, rogue!
Catch am, catch am! Robber, robber!
Catch am - Pull am
Get am - Keep am
Ole...
[Chorus]
Catch am, catch am!
Looking go start
Watching go start - Chasing go start
Somebody go dey -Wey them go grab
Them go beat am well-well
Them go lynch am well-well
Police go come well-well
Them go carry am go court
Them go put am for jail
Them fit put am six months
(Them go put am for one year)
Them fit put am two years
(Them go put am for five years)
Them fit put am seven years
(Them go put am for ten years)

If not them go shoot am well - Them go shoot am for armed robbery
On top of the road, on the side - People dey waka
Office workers, labourer workers, workers' workers

Them go dey try - To try to make ends meet
Them go dey hustle - To try to make ends meet
Them go put hands for back - To try to make ends meet
Them go dey beg oga - To try to make ends meet
Them go be slaves for them town - To try to make ends meet
I say turn your face small - To the right wing
Oga patapata dey for there - Authority people dey for there
Instead of workers - We have officials
Instead of buses Them dey ride motor-car
Instead of motorcycle - Na helicopter
Instead of them waka - Na worker go waka for them

Authority people them go dey steal - Public contribute plenty money
Na authority people dey steal - Authority man no dey pickpocket
Na petty cash him go dey pick - Armed robber him need gun
Authority man him need pen - Authority man in charge of money
Him no need gun, him need pen - Pen got power gun no get
If gun steal eighty thousand naira - Pen go steal two billion naira

[Chorus]
Thief, thief thief!
Rogue, rogue, rogue!
Robber, robber!
You no go hear them shout - You no go hear them shout at all
You no go hear them say - You no go hear them say response at all

Na different way be them way -Na civilize style be them style
[Chorus]
Yes, yes, yes, yes!

"Oh yes, of course, contract, have some money back in hand, ha ha"
Hear the words them dey take deceive the people:

Misappropriation
Maladministration
Nepotism
Mitigation
Make I remember another one wey them dey use
Defraudment
Forgerylization
Embezzlement
Vilification
Mismanagement
Public inquiry

Authority stealing pass armed robbery
We Africans we must do something about this nonsense
We say we must do something about this nonsense
I repeat, we Africans we must do something about this nonsense
Because now authority stealing pass armed robbery

Authority man him go dey steal
Public contribute plenty money...

[Chorus]
Authority stealing!

Image result for fela kuti

Comments